SORRY FOR THE BREAK IN TRANSMISSION No be my fault. Na wetin - TopicsExpress



          

SORRY FOR THE BREAK IN TRANSMISSION No be my fault. Na wetin happen be this... Me sef been dey reason the formation to enter power, I come see say: Nelson Mandela from prison to president. Obasanjo from prison to president. Theodore Orji from prison to Gov. Omisore Iyiola from prison to senator. Al mustapha from prison to Brigadier General. Na hin I come go front of barrack go slap soja man make a fit go prison. Kai... my people, where una wan make a see hand and eye type joke. The kin beatin wey I chop ma people, if a contest for Councillor, I no go win. Ma eye don dey clear small small sha..
Posted on: Sun, 28 Jul 2013 13:23:54 +0000

Trending Topics




En una noche de crudo invierno en el medio de un bosque casi
Skullcandy Aviator Headphones w/Mic3 Wrecked Metals (2012 Color),

Recently Viewed Topics




© 2015