*SPORTS TREK 18/05/2014 NA ONLY FOOTBOL TORI NAI WE GET - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK 18/05/2014 NA ONLY FOOTBOL TORI NAI WE GET TODAY. D Naija Football Federation (NFF) pipo don troway d talk wey bin dey carry on say dem put mouth for d 30 man naming ceremony wey Supa Eagus coachi do last week. Plenty pipo don dey vex since last week wey Oga Keshi don name he 30 man army wey go enta camp for d world cup wey go start next month. Naija fans dey vex say e get plenty playas wey dey d list wey don wound and some also dey wey nor dey see beta ball tap for dia clubs for Yankee. Naija fans also yab NFF pipo say na dem put mouth for d list wey Keshi release lass week. Chairman for d NFF technical committee dem, Chris Green nai con yarn us say na d persin wey Keshi want nai dem approve. “We NFF pipo nor put mouth for d playas wey Keshi wan use becos nai be d coachi and na he work make am name playas. D koko for d mata be say nor be all d 30 man wey dey d list go enta Brazil, and na must make d coachi drop any playas wey no dey kampe as unu know say na 23 dey go Brazil,” na de tori wey Oga Green yarn be dat. Na Arsenal be d new FA Cup champion for England as dem don end nine years agbekpo wey dem nor win cup afta dem come from 2-kondo down take beat Hull City 3-2 for Wembley. D gunnas last win any cup far far for 2005 wen dem beat Manchester United on top penariti to win d FA Cup and dis one sef don jolly dia fans belle as na etighi dem dey dance now for London. Hull dem neva play for big big final bifor and dis na dia fes time sef but dem no show say dem dey fear as dem just rush Arsenal as d match take start. Bifor all men siddon for stadium Hull City don chuk Arsenal two times for eye as James Chester score for d 4th minute as Arsenal begin clear eye dey luk weda na true abi na dream. Like say dat one neva do, Hull kaptin Curties Davies wey Wenger bin dey eye some years ago come add d secon gol five minute afta d fes gol to make am 2-kondo wey ten minute neva do sef. E be like say na dat gol come wake Arsenal from d sleep wey dem dey sleep as Mikel Arteta and Aaron Ramsey begin dey try run tins dey arrange balls for Giroud. Santi Carzola come clean small shame comot as he score ogbonge freekik for d 17 minut to make am 2-1. Na d gunnas hold field but dem nor fit score again for d fes haf even wit d chance wey Olivier Giroud and Lukas Podolski dem get. Laurent Koscielny come later ekwalise for d gunnas for d 71 minute to make am 2-2 as Arsenal begin hol Hull for neck but e no come be as Hull sef come chuk Naija pikin Sone Aluko make he wound Arsenal. D match end for d 2-2 and as extra time show, Aaron Ramsey come score d gol wey go be d winna take helep Arsenal dem win dia fes cup since d last nine years. As e be so, Hull go enta d 3rd round qualifying for Europa League be dat as Arsenal dem fans go begin d jolly wit d new FA Cup plus d regular numba four wey dem come for Premier League. Atletico Madrid don win d La Liga title for dis season yesterday afta dem waka go follow Barcelona play 1-1 for dia house. Plenty tears kommot for d face of all Barca fans becos dem nor believe say Atletico Madrid fit escape for dia house. Na d 3 points nai for helep Barca win d League, but Atletico Madrid do dem bad thing for dia house as dem nor gree make dem win d match. Sabi strika Alexis Sanchez nai fess waya d fess goal for d 33minute for Barca and naso all dia fans kon dey jolly dey dance skelewu, but na 4 minute afta dem start d second half nai Atletico ekwalise. Barca try well well make dem score d goal wey for make dem win de match, but Atletico Madrid nor gree open dia yansh and naso d game take finish. Meanwhile, Atletico Madrid still get d chance to carry anoda trophy ness week as dem go jam Real Madrid for d champions League final. Oga coachi for Barcelona, Gerardo Martino don carry he bag kommot for d club lass nite afta he club nor fit win any trophy for d season wey juss kpai for Spain yesterday. E kon be like say d man sef dey fear make dem no sack am becos na only one season nai d palle take be d coachi for Barca. Plenty Barca fans para lass nite nor be small sake of say Atletico Madrid carry d Spain League for dia house afta dem follow dem play 1-1 for d lass game of d season. Walahi, e for beta for Barca if to say dem try bulala Atletico Madrid for dia lass match becos na d 3 points nai dem need to win d League. Dis na d fess time for inside 6 years wey Barcelona nor go take dia hand touch any trophy for inside one season. Wetin kon vex Barcelona fans be say na dis same Atletico Madrid nor gree make dem enta d lass 4 for dis season UWEFA Champions League as dem bulala dem kommot for d kwatafinal. Na d fess time be dis kuma for inside 7 years wey Barca nor go fit reach de semifinal for de Uefa champions League. Meanwilly, na one time Barca playa Luis Enrique wey juss resign from Celta Vigo be d person wey pipu dey tok say fit become d ness Barca coachi. NA ANATEX KIDDIES WORLD WEY DEY ABEKE RD BY OWUMI NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK.
Posted on: Sun, 18 May 2014 08:42:16 +0000

Trending Topics



left:0px; min-height:30px;"> O el despelote total Los accionistas clase B de SIDOR y la
Gênesis 31 - 1. ENTÃO ouvia as palavras dos filhos de Labão,
Just had an awesome moment this morning. My lovely wife who is one
Ive been off of here for a while, but came back to share this
will some one please remove the creep from mumbai claiming to be a

Recently Viewed Topics




© 2015