*SPORTS TREK 30/06/2014 WORLD CUP AGOROGÓ * Today na d - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK 30/06/2014 WORLD CUP AGOROGÓ * Today na d day wey everybody for Africa dey wait for as Naija wey na dem be d Baba for Africa go enta d same trouser with France for dia last 16 katakata for d 2014 Fifa World Cup. Na 5 African countri dem nai enta Brazil for dis year World Cup, but na only Naija and Algeria fit make am enta d last 16. Since d time wey Naija don dey tap ball for d World Cup, walahi d Supa Eagus norva for dia life fly pass d last 16, and all dia fans don dey pray say make dem bulala France today. D koko for d mata wey dey ground now be say d match go tough die for Naija becos na France carry fess for dia Group, and na plenty goals sef nai dem take kwalify. Naija and France don jam diasef bifor bifor for one play play match wey shelle for d year 2009, and na Naija win d match as dem waya France 1 kondo. Joseph Akpala wey resemble Terry G nai be de Supa Eagus playa wey score d goal wey helep Naija win d match dat time. Naija coachi, Stephen Keshi con yarn us say him and he boys don sit down jeje do family meeting, and na must make he boys bulala France today. Na 5pm Naija time nai d match go take start for Brazil. Abeg na who unu think sef say go win dis match between Naija and France? Oya make unu dey talk make we hear. * Supa Eagus midfida, John Obi Mikel don talk say make all Naija fans wey dey fear cool dia mind becos na must make d Eagus bulala France today for dia last 16 match for d 2014 World Cup. Dis na d first time wey Mikel go tap ball for d World Cup Round of 16, and d Chelsea man wan make Naija enta d last 8 for Brazil. Mikel talk say d katakata wey dey shelle for Naija don enta dia head, and all d playas don gree say na must make dem scata France. “Na everybody for dis world know say katakata dey shelle for Naija, and na hin wan make us win our match against France becos of d pipo wey don kpai d time wey dem been dey watch our match. “Football nai be de only thing wey dey make all Naija fans dey speak d same language, and na to kwalify enta d kwatafinal nai go make all Naija pipo jolly,” Also, France sabi defenda, Laurent Koscielny don tok say Naija go pour sand for dia garri if dem take small eyes jam dem today for dia 2DAY game for dis year World Cup. Koscielny wey dey tap he club football for Arsenal (na inside England dem dey) kon put hand for ear dey warn all he teammates say make dem shine dia eyes well well against Naija. Na France carry fess for dia Group, and dem norva even lose any match for Brazil, but Koscielny tok say dat one na pass tense wey nor go helep dem jam Naija. * Costa Rica don kwalify enta d kwatafinal for d 2014 World Cup afta dem take penarity bulala Greece 5-3 for dia game yesterday. Dis go be d first time wey Costa Rica go carry dia bag enta d last 8 for d World Cup. Na 1-1 nai d two of dem take settle d mata for full time bifor dem kon enta extra time, and as d refuree see say goal no enta net, naso d man blow wisu say make dem play penarity. Greece suppose don bulala Costa Rica afta d refiree waya one of dia playa red card, but Costa Rica golkipa, Keylor Navas nor gree make Greece open he yanch. “Walahi, I don dream am bifor say we go enta d kwatafinal, and my belle dey sweet me now as beta don shelle for our country. “I know say all our fans go don enta street now dey jolly, but I wan make dem cool temper becos dem neva see anything,” naso Michael Umana wey waya d last penarity for Costa Rica yarn our studio. Costa Rica go jam Holland for dia kwatafinal wahala on Saturday, and na for Salvador na hin d two of dem go face diasef. * Holland don enta d kwatafinal for dis year World Cup wey dey hapen for Brazil afta dem bulala Mexico 2-1 for dia last 16 game. But Holland no go lailai forget wetin Mexico take dia eyes see for d match bifor dem kon do about turn win d match. Mexico fans been don dey dance skelewu afta dia sabi strika, Giovani Don Santos waya d first goal for d secon half, but Holland vex waya dem 2 goals for d Eferakeya mortuary time. E remain small make d refuree blow d final wisu as d two of dem dey play 1-1, nai Mexico defenda, Rafael Marquez kon jab Arjen Robben and naso d refuree carry penarity give Holland. Holland strika, Jaar Klass Huntler wey just kommot for bench enta field nai kon score d PK wey helep Holland collect d kwatafinal ticket. *Make I go kneel down for front of Jesus Cross wey dey Banjo Celestial Church for Gana Market, to pray say make France nor clip d Naija Supa Eagus WINGS. NA RCH NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK. RANDY OKOTIE.
Posted on: Mon, 30 Jun 2014 10:15:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015