*SPORTS TREK WEEKEND SPEYUCHA WHICH CLUB GET MOUTH PASS FOR - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK WEEKEND SPEYUCHA WHICH CLUB GET MOUTH PASS FOR DIS FORUM? Today we wan open the floor to see the football klub wey get mouth pass for dis forum. Make unu comment the club wey unu dey support unda dis post. Na d winning club nai go be our FANS OF THE YEAR during our 3rd Year Anniversary wey go shelle by October. Bifore unu go start, make unu read d following Sports tori. Chelsea new numba one golkipa Thibaut Courtois don sign anoda five years kontrak wit d club add ontop de on wey dey run. D sabi Belgium kipa bin sign for d blues dat time for 2011 from Belgium club Racing Genk, but dem come loan am go Atletico Madrid for La Liga. Na there d guyman dey since and dis seasin come bring am bak from dat loan from Atletico come make am numba one for Petr Cech front. I dey jolly say dis day don come. I dey feel high say me don sign for Chelsea for anoda five years. My future don setul, now na to setul to dey play matches remain na so d guyman talk. He don play 23 matches for Belgium and e bin even dey d team wey reach kwata final plus say hin win La Liga wit Atletico and e play for Champions League final sef. Dis tori nai we dey call Kumuyaga. D Village wey Lionel Messi from come for Argentina, dem don ban parents say make dem nor name their newborn omormor MESSI. According to Gonzalo Carrillo, wey be d Civil Register for Santa Fe, he say dem don place embago and na offence by the law if dem catch anybody say he name he pikin Messi, because d name na surname and nor be first name, or guy name. Ogbegbe! Na wah. SELECTED FIXTURES Many ekulele games go shelle dis weekend for Europe. For England, Arsenal go tanda like zuma rock for Emirate to play agst Manchester City on Saturday by 12.45pm. Chelsea go use agbero and ogogoro jersey take wait Swansea City too. Crystal Palace go use plank take wait Burnley. Southampton go use big chest take wait Newcastle United. Stoke City go use shovel take wait Leicester City. Sunderland and Tottenham Hotspur go dig am for one buluku. West Brom go use outside broom take wait Everton. Liverpool go waka alone with Aston Villa. Den on sunday, Man Utd go wear devil asheobi take play QPR. For Span La-Liga, Barcelona go sitdon like Landlord wait Athletic Bilbao as dem go use Bibao take do ram suya. Malaga go welcome Levante with ogbolor soup. BIG MATCH- Real Madrid and Atletico Madrid go do all nite vigil with candle, holy water, olive oil and power bike. Celta Vigo go use frying pan take wait Real Sociedad. SOUTH AFRICA Half human, Oscar Pistorious wey kill he girlfriend wit gun dat year on valentine day, report land our tori desk say Court say nor be full Murder d guy commit. Dem say na half murder wey oyibo dey call Culpable and Neglicence homicide nai d guy do Sapele pipo, all kill na kill. Abi I lie? So now, dis double amputee and paralympiad and sprinter go chop eba for jail for only 15 yrs instead of 25 yrs. Oya make we fly our Club Logo. I be Igho Fc, Sapele. WHO YOU BE? NA UCHE IGBOANUGO CONGLOMENRATES NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK.
Posted on: Fri, 12 Sep 2014 12:49:07 +0000

Trending Topics



="sttext" style="margin-left:0px; min-height:30px;"> Where You Can Find Write Brothers Dramatica Pro Win GREAT
DEJENME VER SI ENTENDI, VOY A COMPARTIRLES UNA REFLEXION SOBRE EL
how to repack pac file(short to the point) 01.open research
LOVE THIS :- Confusion is a step towards clarity. Fear is the
MOTOR CITY THROWDOWN: We took a look at Kevin Johnsons 2015
Chinese counterfeiters sentenced to jail The People’s Court
amsung Galaxy Tab 10.1 P7100
Yesterday when I was getting my hair done by the Fabulous Rebecca

Recently Viewed Topics




© 2015