* SPORTS TREK World Cup Umokurubu * Naija coachi, Stephen - TopicsExpress



          

* SPORTS TREK World Cup Umokurubu * Naija coachi, Stephen Keshi don talk say na lie be all d tori wey dey carry on say he don waka leave d Supa Eagus afta France kommot dem for dis year World Cup. Na afta France bulala Naija 2 zero on Monday nai plenty amebo dey carry d tori say Oga Keshi don waka. But d man don talk now say na pipo nai nor undastand wetin henfollow he playas talk for d dressing room afta dem chop koboko against France. Some pipo even talk say Oga Keshi don chop knuckle with South Africa as he go be dia new coachi, but d man talk say no be so d mata be. “I juss dey pray say amebo pipo nor go finish me one day, becos nor be wetin I talk nai dem dey carry give pipo. “I neva open my mouth talk say I nor dey work again, but wetin I talk be say our match against France fit be my lass game as d coachi becos na afta d World Cup nai my contract go kpai. “Abeg Sapele Tafia, make unu helep me yarn pipo say I neva resign o, but d koko be say d contract wey I get with d NFF don kpafuka as we don kommot for d World Cup,” naso Oga Keshi yarn our Studio. Oga Keshi still talk say “D fess thing wey I wan do now na to go home see my wife and my pikin dem becos e don tey wey I don see dem,”. See fire to fire for Keshi dat day. Lolx * One time Argentina coachi, Diego Maradona don talk say wetin France midfida, Blaise Matuidi do Naija midfida, Ogenyi Onazi wicked pass d teeth wey Suarez take bite Italo defenda, Chiellini. Oga Maradona yarn for television say Blaise Matuidi na “criminal” wey dem suppose carry am enta krench for d bad tackle wey he take wound Onazi. Maradona dey among d football Oga dem wey dey talk d World Cup mata ontop Venezuelan television (Telesur TV) and d man also yab d refurekpa wey blow wisu for d match. “I taya for dat refiree wey blow wisu for Naija v France game, becos d man suppose knack Matuidi red card for dat match. “Walahi, wetin Matuidi do Onazi for dat match wicked pass d teeth wey Suarez take bite Chiellini,” naso Oga Maradona talk ontop TV Meanwhile, Blaise Matuidi also don gree say wetin he do for Onazi nor good at all, and d bobo don beg d Naija man make he nor vex. Onazi fit nor tap ball sam sam for 2 months. * Angel Di Maria nai be d guyman wey score d goal wey helep Argentina kwalify enta d kwatafinal for dis year World Cup as dem manage hama Switzerland 1 kondo. Plenty pipo wey watch d match been don dey think say na penarity nai dem go take settle d match, but Di Maria waya one kain shot wen d match enta 118 minute and naso Argentina take win d match. “I for knack my head for wall if to say we no win d match becos we tap ball pass Swiss, and my belle dey sweet me now as we don fly like adadamu enta d lass 8. “Na all of us try well well for d match, and unu know say nor be all of us go score and nai wan make me troway salute to all my teammates dem,” naso Di Maria yarn our correspodent wey dey Brazil yonda. D kain ball wey Argentina dey tap for dis World Cup dey sweet all man for belle, and plenty pipo now don tanda for dia back. Argentina go enta d same trouser with Belgium for dia kwatafinal game wey go tough pass d second World war. * Belgium don kwalify enta d kwatafinal for dis year Fifa World Cup afta dem waya USA 2-1 for dia lass 16 match wey dem play. USA fans dem been don dey jolly dey think say na dem go win d match sake of say dia boys dey tap beta ball, but na d goals wey Kelvin De Bruyne and Romelu Lukaku score for extra time nai finish USA for d match. E for beta for USA if to say Chris Wondolowski fit score d beta ball wey dem carry give am for d mortuary time, but d bobo juss troway am inside bush. “Na like 15 goals nai we suppose knack USA for d match, but I tank God say we still win d game becos my boys troway plenty opportunity. “All our fans now don dey jollificate as dem dey dance omokormokor dance, and I wan promise dem say we nor go crash for d lass 8,” na so Belgium coachi yarn our studio. Belgium go jam Argentina for dia kwatafinal game on Tuesday ness wik wey go shelle for Salvador. OYA MAKE UNU WISH OGENYI ONAZI GET WELL SOON UNDER DIS POST BECOS HE DEY READ OUR PAGE. NA YELLOW MIKE WEY GET MECHANIC WORKSHOP FOR NEW RD AFTA VICS FAST FOOD NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK.
Posted on: Wed, 02 Jul 2014 10:06:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015