Sho!! which one be dis classification and categorization. How you - TopicsExpress



          

Sho!! which one be dis classification and categorization. How you go know which one be Urhobo, or Ijaw. Even dem Bayelsa boys when dey knack dem fisherman cap, everyone na brodas. Na so I tanda and dem dey gist say Uduaghan do fire Bernard Okumagba of Okere Urhobo Kingdom. I dey ask, where Okere Urhobo kingdom been dey all this time. The gist of the matter be say Uduaghan tell Okumagba:"Migwo" and he never tell am "Vredo" back. That no be ordinary bend down for Oga Uduaghan. Oga Uduaghan expects Okumagba to dey help write checks but he no wan play ball, hence he forfeits.
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 05:34:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015