Sunday news!!! Chairmanship aspirant Chief jubilant Igelige how u - TopicsExpress



          

Sunday news!!! Chairmanship aspirant Chief jubilant Igelige how u Waka with 15million naria water project? Written by Sikocha (our political reporter) We carry our yanch face jubilant igelige campaign poster mess three times pu! Pu!! Pu!!!. Information wen fly enter our studio true back window last nite be say chief jubilant Igelige wen be chairmanship aspirant for Isoko south LG election for DPP and one Primate Moses Ogbodogbo kolobi one water rehabilitation contract enter OYO empire (on your own) As we carry read the kolobi tins wen dem do be say, the matter be dey court since gidigba dey draw ground like Ogbolor soup. The water project wen cause dis katakata na the one wen dem carry give jubilant Igelige say make im do for Oleh pipo and na SPDC, Shell Petroleum Development company of Nigeria give out dis country. When we hear of the total money wen SPDC put for dis water project, our head scatter. #15,647,360.00 naim SPDC nack put for the water project for Oleh community, if to say im do the contract,the matter for portable water supply for oleh community for nor be wahala again. As we carry see the judgment and base on wetting we gather. E bi like say Jubilant Igelige carry both wayo, wen Oyibo dey call forgery take claim d money. We come dey wonder, if chairmanship aspirant fit forge documents take claim contract money wen im nor do, naim be say if im enter our council na big wahala cos dey o cos dis matter wen we dey talk so wear Patari seriously. When court come see the matter dem come Oder say,make dem investigate Chief jubilant Igelige and primate Moses Ogbodogbo well well for the role wen two of dem play wen the water project take enter voice mail. Wetin kolobi two of dem be say, the contractor jubilant nor do the project yet primate Ogbodogbo authorised documents give jubilant make im go collect money for wrk wen im nor do. Meanwhile primate stand for ground say dose documents dem forge dem, say im nor no were jubilant get dem from. While jubilant hold e side say nor be him give am. Na dere the judge wen handle d case Fred O.oho phD come say, if police nor fit do correct investigation of how two of dem Waka, make dem carry the matter give EFCC make dem complete the investigation,make e for better for all of us. Na so d judge conclude for Wednesday 25th sept 2013. Make unu nor forget say na both of dem dey OLeh Exco since.primate moses president, while chief jubilant Igelige secretary. Just yesterday another revolution govt wen dey vex come happen forOleh. as we take hear the matter true front door be say, Na Evang matter Erure preside over the meeting wen bring d new exco for oleh. The matter be happen for Oleh Civic Centre yesterday according to our coven reporter Akpati wen go conver the event. Wetin vex dem wen make dem rebel d old govt from office im never get d true picture but im say e bi like say d matter get leg with the story wen Sikocha report above about jubilant and Moses, meanwhile Akpati still dey up top of d matter once im get more details im go reach us. Meanwhile na the full list of the new excos be dis; 1.Comrade Julius Malam-Obi Interim President 2.Mr John Igbudu Interim Vice President 3.Mr Blessing Okpro Interim Secretary-General 4.Mr Goodnews Utoro Asst Secretary-General 5.Mr Dickson Amare Treasurer 6.Mr Mariogha Osibi Financial Secretary 7.Mrs Josephine Egbo Women Leader 8.Mrs Ann Egbure Asst Women leader 9.Deacon Emma Eto PRO 10.Bar Rockson Igelige Legal Adviser 11.Mr Desire Udoma Welfare Officer Abeg our pipo we dey go church first go conduct pray for dis oleh matter cos the tire get as e bi make u self go church to pray too o. Isiegwaree ISOKO MUST TO BETTER IJN
Posted on: Sun, 29 Sep 2013 07:57:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015