Supa Eagus strikas, Victor Moses and Brown Ideye don enta Naija - TopicsExpress



          

Supa Eagus strikas, Victor Moses and Brown Ideye don enta Naija camp wey dey for Durban dis afternoon, but small yawa don shelle for Naija as Chelsea midfielder, Mikel Obi no go fit jam de Bafana Bafana on Wednesday bicos him body no dey kampe. Na 2pm today be de time wey Victor Moses carry him bag enta de Supa Eagus hotel and naso him belle kon dey sweet am wen him temamates dey halla him name. “My belle dey sweet me well well as I don join my padi for de game wey we go play tomorrow (Wednesday)”. Naso Moses take yarn us for supersport. Minwile, Naija coachi, Stephen Keshi don yarn bifor for de amebo tok tok wey dem do (oyinbo dey call am press conference) dat Mikel no go tap ball for Naija tomorrow, but de coachi add jara dat even tho Mikel, Kenneth Omeruo and Emenike no go fit face South Africa, de Big Boss tok say Bafana Bafana go still chop bulala for de play play game. Supa Eagus of Naija go train dis nite by 8pm wey be (7pm for Naija), but na for de Moses Mabhida Stadium na hin dem go train. The Naija Boys don dey jolly for dia hotel as plenty of dem dey play snooker, while some dey hia music dey dance kukere. Golkeeper Austin Ejide na him go be de Eagus skippo for de match on Wednesday as de two Naija captain (Yobo and Enyeama) no dey for dis play play game. “We dey here to do de thing wey our coachi wan make we do, and na like Lion na hin we go take jam de Bafana Bafana bicos na we be de Baba for Africa and we no go take small eye look dis match,”.
Posted on: Tue, 13 Aug 2013 16:46:36 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015