TGIF. E get this particular - TopicsExpress



          

TGIF. E get this particular restaurant wey I dey chop for VI, e get one oyinbo wey dey always com chop there too. Any time dis oyinbo chop finish he go shout "HEY", so I wonder wetin dey make am shout, I decide to chop wetin the oyinbo dey always chop so I go shout too. When I reach the restaurant last week Friday, I order wetin the man dey chop. They tell me say na chicken and red wine, so I chop am, but I no shout, I collect xtra plate but still I no still shout. Na then I just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken na N35,000 & red wine na N25,000 then the extra plate na N20,000 na then I shout heyyyyyyyyyy! heyyyyyyyyyyyy!! heyyyyyyyyyyyyyyy!!!
Posted on: Fri, 27 Sep 2013 17:42:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015