THURSDAY 7TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: Our news today na just about - TopicsExpress



          

THURSDAY 7TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: Our news today na just about this EBOLA disease wen don dey chop people dey come soooo, but bfore we start make we first throw una our usual Auchipoly daily news......... DAILY NEWS: Finally Yesterday nai this year auchipoly post jamb UTME exam finish with business admin we wish all of una success in jesus name Amen............ Heavy report dey reach us say some people no write dis exam due to say their computer no gree display question and some come late, abeg we dey beg school management make dem try organise another exam for them so dat their 5000 no go waist oooooooo.............. HND form go soon come out, even as I dey talk soooo HND students don full dis school dey wait for the form, make una no worry we go help una hammer dem so dat d form go show quick.............. This year post UME result go show for october/november and waiting una score no concern school na only the admission list dem go bring out that time so make una go pass were una know say e save take do una own cos na who strong pass nai him name go show oooooo..................... Payment of this year school fees still dey on for the various banks and dem never add any additional fee put oooooo as na still d same amount, abeg make una go pay so dat dem go fit pay our PAPA and MAMA wen be lecturer ooooooo.............,..... AUGUST 7TH BIRTHDAY LIST: 1 Umoru Dereck. 2 Emanuel kelvin. 3 Iyama kelvin. 4 prince Cy. 5 Jeremi Arnold. 6 Abotu favour. We wish una long life with sound health and many money with plenty pikin in Jesus name Amen.......... Winners chapel go do their praise nite on friday @ the new Auditorium by 3pm and many guest artist go dey there live with Frank Edward and Sinach coming so make una no miss ooooooo and remember say winner no get African man time cos if u no quick come sit no go reach u ooooooo me I go dey there live............ Polyweek don reach and na 11 of August wen be nextweek nai dem go start as we dey expect top Artist like Tiwa savage and other guest for the polyweek so make una go dey sow una old school day cloth oooooo especially all the finals.............. If you get any news,info,advert or birthday wishes make u inbox us we go help u post am here live............ Na there we go take end our normal Auchipoly news for today, now make we enter the main news proper........ EBOLA VIRUS INTERNATIONAL (EVI) That na the name wen we give am bcos na international virus wen dem don bring come again to take make money just like AID/HIV...... Dem say na liberia man nai bring am come 9ja and na American he for get am, why e b say if we travel enter Europe dem go begin check our teeth and all our body bfore we go enter their country and if dem wan come our own we go allow dem pass like ant? Make our government answer dat question oooooo................ Ok just last week nai liberia government begin shoot school down to avoid the spread of the disease and now for liberia dem dey troway any Ebola dead patience for road like dat, my people dat 1 good?................ But make we think am oooo some people go say God nai dey give and na him dey take me I no sure say dat na true becos American and Russians na create dis Ebola disease d same way wen dem take create AID/HIV from their lab becos say dem wan do nuclear weapon and dem come carry am come Africa come experiment am for Africans body. One thing wen una must know b say e no get disease wen no get cure! And American get the cure to dis disease bcos this Ebola na man nai make am....... Just yesterday na we dey here say one Nigeria female doctor wen dey treat dat liberian man bfore he die don die for Ebola disease......... Our Nigeria doctor dey her own ooooooo wen dis Liberia American man come from liberia come spread am for Nigeria here and we come hear say d 2 American doctor wen contact the Ebola virus wen dem dey treat some patience for liberia dem don fly dem go American last week and from d latest ABC and Goodmorning American news say as of today those 2 doctors don dey recover small small so d question wen I wan ask b say y our own doctor go come die?.............. American dey use our head ooooo for this Africa and dem get question to answer. Concerning dis disease cos na dem nai bring am come with their so so lab things wen dem dey do, and our stupid leader go just dey find their own personal interest while d people wen dem say dem they protect Dey die troway like fly........... According to report dis disease don dey exist since 1976 why dem no find cure for am since? Make dem hold all dis our so call leaders responsible oooooo. Cos according to one radio programm yesterday one Nigeria herbal man say he get cure for the Ebola disease but of doctor dey say no cure! And for many years now Nigeria government no one gree use herbs as a major way of treatment instead dem prefer Abroad own. my people d thing wen government dey do so good? Thank God say EBOLA na senior brother to AID so e go fit enter anywere even ASO ROCK self................. The last report wen we come hear yesterday nai be say the USA government get cure for the Ebola disease and nai dem take dey heal those 2 doctors sooo but before dem go treat any Affected patience, the patience need to get their medical data base identification (MDBI) and dem say without dat code dem no go treat the person and dat code nai be d mark of the beast wen bible dey talk about soooo. Dem bring dis virus bcos dem no say na d only way dem fit take convince to join dem for the underworld. Hmmmmmm tshia..............there is God oooooooo dis virus u people are sharing there is God ooooooooo.............. So we dey call on our government to make sure say dis nonsense no spread ooooo cos we hear yesterday for channels news say 7 Nigerians don dey Effected for lagos there 5 of them run and 2 nai dem fit catch hmmmmmm make una find the other 5 people ooooooooo........... With dis note now we don know say d only way wen we no go fit get am na to dey vigilant and avoid hand shakes or f possible always put on hand gloves and if you see any form of the symptom for anybody body weda na ur friend,family members or lover make u alert the nearest police station of security agency wen dey near you oooooooo.......... The picture wen dey ground so na d Ebola patience for liberia wen dem dey troway for road now like rat............ Finally this na the prayer wen we go they pray every day for our daily devotion, EBOLA SHALL NEVER COME TO ME MY FRIENDS OR MY FAMILY MEMBERS IN JESUS NAME AMEN............. My people how una see waiting we talk soooooo e correct abi e no correct make una share am for all una facebook friends make dem also talk their view........... NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY AND D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY, Nai dey give una dis news, abeg make I go see my honourable dean of students affair with d 12 names wen I don get una bye bye............
Posted on: Thu, 07 Aug 2014 05:57:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015