TRUE... When I enterd dis school my plans was to be gud to - TopicsExpress



          

TRUE... When I enterd dis school my plans was to be gud to people, stay loyal Read my books Graduate nd take my certificate. Buh I knw Satan wont gree, I gat many frnds, dem de say many fins both gud nd bad lol. U knw as a bold guy who can address the public, girls go dey winks u knw na... Some frnds be like guy use dis opportunity geh one RICH girl and also play in di league of RICH girls lolxxx I was like na true oo but its not one of my plans... Dias a girl I de wink she dey wink me also, hw we found ourself Chatting on whatsapp we dont knw lol fear girls No be say we dey Date oooo #bad mind# lolzz we be gud frnds ... Dat same group of guys carry dia own enter again oo. Dem be like Chinweike Tempt dis girl jus to know her mind over u... Lolz di Advice cute oo but I told dem Na same Temptation dat made me loose many gud frnds dem say I too de fear make I try am first if I loose her dat dia are many girls out dia wetin for me to say HI... Den if I didnt loose her two of us will be two best friends In school... See brain washers oo I said ok oo. I enterd whatsapp nd she was Online I begin wif... ME: Hey, I want to say Something. SHE: Hmm swidy with this manner? ME: Spare me dat Ok, Emm can u give me a break?( As I dey type am my body nd hands de shake oo lolzz) SHE: Pls, how do u mean?? Pls Talk to me. ME: I jus need to stay On my own for a while. SHE: OFFLINE last seen 1:57pm. My dear I gat up to 17 missed calls from her nd my head dey swell lolzz.... I dey my Room de play music wif my phone... Strange hand come dey bang I was shocked maybe na dis woman wey I carry One bag Pure water from her shop nd I neva pay, I come peep from little hole on ma door. Na di Girl oo lolz I come open door Her face be like who don cry di first round... I cant control my Emotion dia lolxx I started laughing nd I draged her inside she now cry di main cry. I am laughing nd she was mean and busy shedding tears. Mua dey snap her pictures lol... Well I later cuddle her and apologisd I said to her Abeg na Joke ooo i wanted to knw what you will do and now I have seen wat u ve done. Nd I begin wif dis romantic words lolxx U knw na winks. I later said to her so we are jus frnds and u ar crying dat means if we start dating nd dis kind fin happen na jus die lolx ....At a time nepa bring light... She begin dey smile small small. She said, So you dont mean it? I said yes o jus kidding We laughd together AND... ( Abeg close ur ears jarrehhh I wont say wetin happen Next cos na Only me and her dey di Room and Fan don cool our body so lol)
Posted on: Tue, 05 Aug 2014 03:01:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015