Tell your mama, Tell your papa say life go better for you. Owan - TopicsExpress



          

Tell your mama, Tell your papa say life go better for you. Owan People, time don reach to support una pikin Christopher .i. Ojo for House of Representatives, Owan... make him go help una for the Legislative house when dey abuja. Time don reach to go claim and return all the good things when the people when dey office kidnap before. Youth development, Una go get am. Good market/business environment, Una go get am. Thiefy Thiefy Jankorico, E go stop. I go use my office chanel millenium development come our constituency School, our people go begin go school without fear of strike and money to buy book. All those fertilizers when federal government don pay put for us, when him be say na politician when be farmers dey go pack am, i nor promise say e go stop, but the one when rightfully belong to our constituency, WE GO GET AM. Owan People Awarise oooh !!!! Abeg make we follow the millennium goals ooh.
Posted on: Mon, 01 Dec 2014 06:51:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015