The Lord na my Shephard, i dey idigbaa. E make me sidon for wher - TopicsExpress



          

The Lord na my Shephard, i dey idigbaa. E make me sidon for wher betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteouness sake of hin name Walahi! If I waka pass where arm robbers,boko haram, 419 and juju people plenty, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai body dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na them dey like back bone dey comfort me. You don prepare Egusi and Pounded yam with plenty-plenty meat, fish and Ekporoko make I chop. All mai enermies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion.Mai cup na River Niger wey overflow hin bank. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY NA U BIKO. Amen!
Posted on: Tue, 03 Sep 2013 20:49:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015