This matter wey I wan drop so no long but e dey important. D - TopicsExpress



          

This matter wey I wan drop so no long but e dey important. D matter short like Aki and Paw paw. But e make sense like Mama Oghale Rice and Stew. BREAST FEEDING MOTHERS Na very good thing say when pikin dey cry, make the mama give am breast suck immediately. Before mama suppose give her pikin breast suck, she go first of all 1- Find a good sitting position wey go fit allow the pikin suck well. 2. She suppose to clean the nipple of her breasts well so that the pikin nor go suck dirty. Sometimes, when mama dey cry because of one issue or the other, and her baby dey cry for breast, e good make she use water take wash her breasts first before she breast feed her pikin. Now, wetin bring the issue at hand na the ways some of our young mothers and ladies dey take dey breast feed pikin for public place. Unu know say, many young mothers now, if dem nor tell you say dem don born, or you nor see pikin for their hand and back, you nor go gree say dem don born. Why? Dem dey dress well and dem dey take good care of their body. But, the way dem dey take dey open their breasts outside if pikin dey cry, dey make somebody vex. Some ladies go dey where guy men full, open breasts dey feed pikin. E nor good o. Sapele mothers, woman breasts na one of the selling points for woman beauty. If man see am, e dey make wire spark for man brain. And if your husband notice say another guy man dey see him wife breast all in the name say she dey breast feed pikin, na very bad thing. E dey make man vex. Wetin unu go dey do nai be dis... - if you want to breast feed pikin for public place, try go corner. - if you nor fit go corner, use handkerchief, or wrapper, or face towel take cover the breast wella make pipo for nor dey see am. Na wetin eye see or wetin hand touch or wetin body feel nai dey make prick raise. Cover your pikin foodland. Cover your husband property. And cover your own pride. Woman breasts nor be wetin dem suppose dey expose. And to all those shikalas wey norva marry but becos of fashion, dem come go draw tattoo for breasts, make unu take very good care. Nor be becos of your useless tattoo wey dey your breasts, you go come dey wear things wey go dey show your breasts to the public. E bad o. E bad wella becos we all suppose to dey act responsibly. Nor be every matter mama dey hear o. So, I stop for here so that those when this issue concern go fit get time take think am well and adjust. And as for the men, make unu still dey correct women wey dey do this kain things for unu present. For our culture, na only great grand mother nai dey use ordinary breasts take dey do singlet. Nowadays, if you see some grand mamas, you go wan toast them because of the way dem package. So, make we dey package our breasts well o. I dey go pump my wheel barrow tire for opposite Eternit. I dey come. OUR STUDIO STILL DEY EXPERIENCE THE FAULT, NA ANODA SOURCE WE TAKE DEY UPDATE SO. GOD BLESS YOU
Posted on: Fri, 31 Jan 2014 12:15:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015