Tori For Town: For inside dis season of love, the members of one - TopicsExpress



          

Tori For Town: For inside dis season of love, the members of one family wey dey KwaZulu-Natal, South Africa, bin get big wahala inside dem compound, as one of the ladies for the family bin stab her elder sister. The kasala bin start after the younger sister bin notice say her very expensive white pant dey lost, wey as she accuse her elder sister say nah she steal her pant, but as the elder sister bin deny say no be her nah so the younger sister bin break bottle take stab her sister for nose. Police talk person Colonel Jay Naicker bin talk say Inanda Police bin arrest the younger sister ontop charges of assault with intent to cause grievous bodily harm & the bail nah $500,000… Bigmo (@bigmoNaija) dey ask wetin don bring heavy quarrel between you & your elder/younger sister/broda? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #LoveAndResponsibilityTuesday Twitter & Instagram: @WazobiaFMAbuja Tel: 0709-2222-995 wazobiafm/abuja995 Whatsapp: 080-999-30172
Posted on: Tue, 16 Dec 2014 05:35:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015