Tori For Town: Inside yesterday during the opening of the All - TopicsExpress



          

Tori For Town: Inside yesterday during the opening of the All Progressives Congress (APC) Presidential Flag-bearer, Gen. Muhammadu Buhari (retd.) campaign office & the presidential campaign council inside Abuja, Buhari bin dey ginjah im supporters, come advice dem say “make dem no insult or dey rude to any leader on im behalf becos dat wan go spoil dem party name, say the opposition party dey follow wetin dey law. So therefore make im supporters learn how to dey shin dem eyes/vigilant before, during & immediately after elections, plus say make dem no take law enta dem hands, no matter the kain provocation wey happen. Im still yarn join say once APC begin rule Nigeria, say no Nigerian go experience hunger or vexation before dem climb dem bed sleep effriday… We know say nah “we we” bad belle people dey use cause wahala during or afta elections, but Bigmo (@bigmoNaija) wan know weda you still remember wetin happen during 2011 general elections & weda you don ready to vote without causing any kain wahala inside dis February general elections? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #LoveAndResponsibilityTuesday Twitter & Instagram: @WazobiaFMAbuja Tel: 0709-2222-995 wazobiafm/abuja995 Whatsapp: 080-999-30172 vanguardngr/2015/01/dont-take-law-hands-buhari-tells-supporters/#sthash.kM4L5GMF.dpuf
Posted on: Tue, 13 Jan 2015 05:33:01 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015