Two German entrepreneur don launch a phone service where you fit - TopicsExpress



          

Two German entrepreneur don launch a phone service where you fit release all di anger wey dey ya belle. Di swearing hotline, known as “Schimpf-los” (“swear away”) in German, has operators wey dey standby seven days a week for frustrated people to jeer at, taunt, abuse and use all manner of colourfull language on. Instead of to go home to shout for ya husband or wife wey no cause ya wahala , you just call di swear line and get everything off ya chest. Di service costs 1.49 euros per minute , chei! that one fit add to di annoyance wey dey worry person but di owner Mr Schulte feels di money dey justified for di service “For getting everything off your chest, it’s a bargain.” he said Naija wey fraustration don pitch tent dis one go be better business oo. Naija version go be like dis: ” Una welcome to di swear away hotline. Please listen to all of the options before making your selection. To belittle & yab your government, press 1. To take the Lord’s name in vain, press 2. To rant about your spouses nagging, press 3. To call your boss obscene & abusive names, press 4. To launch an f-bomb at the world in general press 5. To swear for Boko Haram, press 6 At least recession don dey create business If you like this , click the buttons below and share with your friends in facebook
Posted on: Fri, 05 Sep 2014 06:00:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015