U Travel from Lagos to one Village wan go do juju to charm one - TopicsExpress



          

U Travel from Lagos to one Village wan go do juju to charm one Guy. As u reach d Babalawo Place 4 Villa,d Baba kon ask u sey wetin u want and u kon start: *Baba e get dis Bobo,d Bobo get Money well well. Baba i nid dis Guy...... Baba go kon ask u sey so wetin u want make i do d Guy? U kon Breath down hummmmm kon sey Baba d Number 1 thing b sey i want make dis Guy turn to my Maga as in... Any thing i ask am im go do sharp sharp. 2 i want make im no dey see another Woman apart from me. 3 i want make im Prick dey die except wen me and im dey and d last Baba i want make im 4get im Mama 4get im Papa 4get all im Family make everything wen im dey think b me me and me. Baba thats all. Baba kon tell u sey dat na small thing but u go nid to go bring d guy Picture and u kon tell Baba sey u Bring d Picture already den u kon dip hand inside ur Bag bring out d Guy Picture carry give Baba. Lo and behold d Guy na D Baba Pikin,only Son 4 dat mata,inshort only Child. P-Square and Lagbaja dey sing 4 u.. Like Glo.... Ur Kraze go be UNLIMI.......... UNLIMITED!!! Ruffy
Posted on: Sat, 15 Jun 2013 17:54:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015