U celebrate birthday 4 nightclub dey do opening prayer- Na God - TopicsExpress



          

U celebrate birthday 4 nightclub dey do opening prayer- Na God go slap ur mouth. U come back from Dubai dey form British accent. - Na rat go chop ur mouth U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss. -4 where na.....mumu U dey add water to egg say e go plenty when u fry am. - Why u no add yeast join am....olodo. U no go university, & u dey find ur name 4 NYSC posting. - Na yeye dey worri u. House dey burn, u wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....na end of discussion be that. U dey say Terry Gs music dey inspire u - if u end up in yaba left, i no go blame u!! madness U carry candle dey look 4 where fuel dey smell from.- continue u go soon see am U call Etisalat 2tell dem sey ur free chat browsing has stopped working. - Lolzzzzzzzzz... Worlds wisest mumu When pastor talk say Do something crazy 4 the Lord u come carry church offering run - na God himself go chase u..... U read dis & u no share am wen u smile finish - na only u de Stingy 2 d last... Share make evrybody laff Joor. Gud morning :)
Posted on: Tue, 19 Nov 2013 06:40:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015