U celebrate birthday for nightclub dey do opening prayer- Na God - TopicsExpress



          

U celebrate birthday for nightclub dey do opening prayer- Na God go slap ur mouth. U come back from dubai dey form British accent. - Na rat go chop ur mouth U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss. -4 where na.....mumu U dey add water to egg say e go plenty when u fry am. - Why u no add yeast join am....olodo. U no go university, and u dey find ur name forNYSC posting. - Na yeye dey worri u. House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....na end of discussion be that. U dey say Terry Gs music dey inspire u - if you end up in yaba left, i no go blame u!! madness U carry candle dey look for where fuel dey smell from.- continue u go soon see am U call Etisalat to tell dem sey ur free cheat browsing has stopped working. - Lolzzzzzzzzz... Worlds wisest mumu
Posted on: Fri, 15 Nov 2013 21:07:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015