U dey do opening prayer 4 Night Club. - Na God go slap ur - TopicsExpress



          

U dey do opening prayer 4 Night Club. - Na God go slap ur mouth. U come back from dubai dey form British accent. - Na rat go chop ur mouth U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss. -4 where na.....mumu U dey add water to egg say e go plenty when u fry am. - Why u no add yeast join am....olodo. U no go university, and u dey find ur name forNYSC posting. - Na yeye dey worri u. House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....u don die. U de say Terry Gs music dey inspire u - unto which level!! madness U carry candle dey look for where fuel dey smell from. -continue u go soon see am U call MTN to tell dem sey ur free browsing has stopped working. - Lolzzzzzzzzz... ..mad man When pastor talk say Do something crazy for the Lord u come carry church offering run - na who wan chase u?..... U read dis & u no share am wen u smile finish - na only u de Stingy 2 d last...
Posted on: Sat, 02 Nov 2013 15:54:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015