Update/Am News: Sunday Akoni wey e belle be like woman wey wan - TopicsExpress



          

Update/Am News: Sunday Akoni wey e belle be like woman wey wan born twins,,i don warn you time without number say make you desist from that issue of land wey you go involve yourself. That innocent boy wey e come from Ghana(Happy Umukoro) wey e norva last month,,na he you go arrest since yesterday sake of say he price land from you and Satur and after all he come go buy from another person. Wey the boy noticed say una land na waya land ,,tell me why he nor go run? I give una 2hrs ultimatum to release that innocent boy now or else na trumpet i go blow for army 028 and na that bunkery/pipe vandal i go hold against una. Sunday Nepa we only now you to be welder before,,but thanks be God wey touch Stephen Ikewun before he connect with influence to the Nepa work. All this things wey una dey thief from our transformer,,make una desist o,,or else na that electric go still kill una if una nor stop am. Sunday nepa,from now onward i don assume you for security job to guard all the transformer for the land..........congrats for the new job. I nor wan know whether na super or flourish nai them award the road contract give,,but all i know is for all the Jesse politicians to bow their head together and fill or renovate all the pot holes from that Efemini junction to that Osadahe house. I refer to the politicians because na they award the contract give those people,as their loyalist. Una wey dey do breaking and entry for the town,,una go break enter house finish and una go still dey wan rape women. Una days don number. But where all the Vigilantees for the town self?,,abi una don change to vigilanthief?..............from now on if i still hear about the issue of breaking and entry for the town again,,una go come give account,,because soldiers,,even police nor too know more about the in and out of the town. Na una wey be indigen nai e know all the ikoroh of the town,,nai e make we get una as vigilantee,,so you guys should be vigilant to fish out all those boys wey dey perpetrate the town. Make we the indigens of the town still dey at alertive and report any suspicious movement by night to the police or inbox me to make our Jesse land a better place. Jesse Must Better.
Posted on: Thu, 08 Aug 2013 11:12:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015