WEDNESSDAY 10TH AUCHIPOLY MIDWEEK NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

WEDNESSDAY 10TH AUCHIPOLY MIDWEEK NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOO.......... Report use ebereme market take enter our studio say after the meeting yesterday wen madam rector hold with top officials them come decide to shift the spat exam due to say many activity full ground from on the 26th to 6th of oct, so as we take ear hear am now spat exam na 6th of october nai e go take start ooooo............ Report still reach us through mama queen bar say HND exam go start on wednesday 24th of september to 27th of september and the form go expire on the 22nd so make una take note............ Report take ekelebe joint take enter our studio say ND admission list don almost ready and na from on the 19th of october them go begin paste the first batch.............. Another report take back of uyi ground joint take enter our studio say SUG excos don lay allegation for 9ICE,ALABA,SADO,AM XPRESS AND DEAN say dem travel go Abuja go see our 9ja 01 goodluck jona and he come give dem 20 million, abeg first of all una think say e easy to see 01 of 9ja, abeg make una no dey talk waiting no happen oooo bcos men go take casala take run enter una ooooo........... Report take flying bullet take enter our studio say dem give SADO 3 million to take do him project na he use am take buy 30 chairs and clear bush for campus 2 come talk say na him project be dat, hmmm something wen no reach 200k if he too much, e come even they ask of more say he no reach nai madam rector tell am say make he just quite he mouth if not he go refund the change wen he remain, na only who no get the students for mind nai go fit do this kind thing, and na only God nai go pay u for the things wen u do for auchipoly students good or bad............... Report reach us from one Henry Omaye And this na waiting he talk! Abeg APT i need to buy laptop help me post am if anybody get laptop to sell make he contact me with dis no 08164746110, So if u get make una call am oooo.......... This na waiting somebody send give us yesterday: Abeg I be 4rm ND1 computer science department. Abeg make help us tell Chete (dean of ict) say d JAVA question wen he set giv us on friday last week 2 hard. So make he tell d ppo wen wan mark am 4 am say make dem use easy easy mark am, make we all 4 dey smile if we see our grade cus i knw say Cynthia Osas (CO) nor b our portion. Hmmmm make una no worry I trust my dean he no dey tear Carolina anyhow............ Report use flexy garden for much street take enter our studio say e get 2 brothers wen b lecturers for OTM department say dem sabi knack students C.O well well and dem for this first simester wen pass so dem give ND final C.O. Anyhow, now dem say the one wen dem dey call Ben iredia don dey collect 10k for ND final students hand for project while he bro Peter Iredia dey collect 20k for HND final hand for same project, hmmmmm una one build airport abi for the same family, una better stop ooooo or else the iredia family will lost their job ooooo...................... Report take idogho market take reach us say mass com students dey suffer as their ND 1 spat result dey their class rep hand for him house which no suppose b so and even if them wan check am for their exam officer hand mr kasim he go tell dem say make dem go bring 100 naira come first, abeg make una go paste their result ooooo class rep and exam officer if not na panel una go land oooo, also report still reach us say one Mr Umolu give about 35 students C.O after all the many assignment wen dem do and text but wen dem latter find out dem come see say na him boy Mr no wahala nai he give take mark am, hmmmm Lecturers una no go change dem dey pay ur boy? If rector hear am na abuja direct ooooo............ Na here we go take end our news today my people how una see our today news make una tell us bcos na una nai be our voice oooooooo........... AUCHIPOLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME TAFIA THE OTOTA OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY Nai dey give una dis news so, abeg make I go the compiling office were dem for they arrange the ND admission names, una bye bye...........
Posted on: Wed, 10 Sep 2014 06:53:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015