Wahala go shelle today for UAE as de Naija small pikin team wey - TopicsExpress



          

Wahala go shelle today for UAE as de Naija small pikin team wey all of unna dey call dem Golden Eaglets go enter de same trouser with Mexico for de final katakata for dis year U17 Fifa world cup. Naija don win de cup 3 times bifor bifor and plenty guymen don tanda for dia back say make dem win am again. Na Mexico wey de Eaglets take drink garri for dia fess match na hin dem go jam again and plenty Naija fans don dey tok say de match go tough die bicos Mexico go wan revenge de 6-1 kondo wey Naija knack dem. Oga Victor Ikpeba wey dey among de Eaglets boys wey tap ball for de 1989 world cup kon tok say Naija go hamma Mexico for dia final match on Friday. “We wan troway salute for de Eaglets playas bicos na beta ball na hin dem dey play for dis small pikin world cup,”. Ikpeba wey dey among de Golden Eaglets technical committee wey dey for UAE kon add more jara to im yarn dat de Eaglets get beta playas wey go helep Naija for future. “Taiwo Awoniyi, Kelechi Iheanacho, Dele Alampasu, Musa Mohammed, Chidera Ezeh and Chidiebere Nwakali na playas wey go helep us for future,”. Minwilly, Sweden and Argentina go fess jam diasef for de third place match bifor Naija and Mexico go enta diasef. Friday, November 8 Sweden vs. Argentina SS3HD, SS3, Select 2 (2.45pm CAT) Mexico v Nigeria SS3HD, SS3, Select 2 (5.40pm CAT)
Posted on: Fri, 08 Nov 2013 05:00:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015