Walahi, Facebook don dey fear me. See Facebook wey dey make us - TopicsExpress



          

Walahi, Facebook don dey fear me. See Facebook wey dey make us happy, don turn to another thing. People go dey beef themselves for Facebook like say na Bank work; insults and gossips here and there. All in the name of APC and PDP na wa ooO And the thing dey taya me unto say people dey beef people wey dem never see ooO, chai. Just imagine say person dey beef me, wey him or her no know weda I be Spirit. Kai, people get work ooO. Na so when I begin my small small write-ups dem, plenty people insult my mama and papa...people wey no know me ooO. Mehn, I been cry those days fa...and I been wan stop to write sef, na my Padi advice me make I bone dem. See ehn, Facebook don turn one chance walahi. I dey fear because the kind politics wey dey happen here dey taya me. My people, wetin be that thing wey una dey drag for facebook sef; abi na allegiance or loyalty? Person wey no dey feed us, house or clothe us go dey para like say him/ she be Galadimma. Wait, make I yarn una... wetin una dey gain from all these fight and insult wey una dey engage unasef for Facebook. Una go dey form political camp with people wey una no go ever see for una life, na wa o. Any day wey I enter Facebook, na so so fight I dey see...mehn, trust Nigerians na, no where wey dey no dey form groups and counter-groups. I don talk am before and I go talk am again, nobody for this world go get mind come my side, come dey brainwash me make I bone my friend, say my friend na bad person....nobody ever, fit try am with me. Even yesterday, person begin insult me for my sweet poem oo...lolzz, She no know say I be ROBOT wey no get emotions sam sam. Ehen, make I give una one expo, una know say when people insult una and una no send them at all, say e dey pain them? So una no know, chai....and e dey sweet well well if you ignore ionsults, if I dey lie, make una try am and see. Plenty people dey get jobs and win scholarships for Facebook, una own na to gossip and insult una fellow human beings....them do unaaaaa, haba. Me dey Facebook to socialise and be happy ooO, I no come Facebook make person come dey tell me wetin I go do. E don tey wey I even exchange words with people for Facebook sef, since last year na. If you like insult my big head or my family, lolzz.....I go dey look you like Zombie. You know wetin dey funny me? People wey sabi insults and curse people parents, na people wey sabi fear ehn. They go just hide behind their phones dey unleash vitriol. Abeg, I dey beg una....e don do. Facebook no be competition, nobody go give you award for insulting Ghosts. We come here to make new friends and share opinions. No allow anybody intimidate you for Facebook, abi you dey fear say them go beat you? How dem wan beat you na? Them be witch? I go Surport BUHARI
Posted on: Thu, 22 Jan 2015 09:03:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015