West Africa Common Pidgin Proverbs Craze no hard to form, na the - TopicsExpress



          

West Africa Common Pidgin Proverbs Craze no hard to form, na the trekking be wahala. English translation: Easier said than done. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. English Translation: Calm down, your temper wont solve the problem. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup. English Translation: You cant run away from your destiny. Todays newspaper na tomorrow Suya wrap. English translation: Keep calm! Nothing lasts forever. Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef. English Translation: Just be patient. Let the game come to you. Dont rush! Akara and moin moin get the same parent,na wetin dem pass through make dem different. English Translation: How you start doesnt matter, what matters is how you finish. Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus. English Translation: Give everyone what they deserve. The difference between puff-puff and doughnut na packaging. English Translation: Dont judge based on appearance alone. Escort me, Escort me, na im slave trade take start. English translation: Serious things sometimes start like a joke. The water wey dem use take make eba can never be recovered back. English translation: Dont cry over spilled milk. You can add yours... let the fun continue... **GR8SAM**
Posted on: Tue, 13 Jan 2015 08:29:35 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015