Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with - TopicsExpress



          

Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures presents anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013. Dis one na movie wey pass movie ooooo. Dem no dey tell person dis 1 oooo, u must to watch am by ursef. Come hear the true story behind the whole Asuu Strike ooooo- who start am, why dem start am, who supose end am and who no gree end am ooooooo! U go see all for dis movie. Money don scatter our country ooooo, dis 1 dey ask 4 money, dat 1 say no money.....ewoOo ooo Chai com see as university student dey suffer, c as crime dey increase. Girls dey born fowl, yahoo men dey press die...See Blood! Blood!! Blood!!! rich man no even worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger, garlic... Dat will kip u glued to d edge of ur seat .U go laff,u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Directed By Chi_ne Group, Starring: Kanayo. O. Kanayo as Goodluck Jonathan Pete Edochie as Nassir faggie Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Ruqayyat Ahmed Rufai and Olu Jacobs as Gabriel suswan.. Jim iyke as yahoo boy, sacca na poor man oooo. ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now..!!! Remember that Jesus is coming soon.
Posted on: Sun, 27 Oct 2013 06:09:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015