Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with - TopicsExpress



          

Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures present another ogbonge movie ASUU STRIKE 2013.Dis one na movie wey pass movie o! Dem no dey tell person dis one o! U must to watch am by urself & for urself. Come hear the true story behind the whole ASUU Strike. Who start am, why dem start am, who suppose end am and who no gree end am! U go c all for dis movie.Money don scatter our country o! Dis one dey ask 4 money, dat one say no money...ewoOooo o! Chai! Come see as University students dey suffer, see as crime don dey increase, girls dey born like fowl, yahoo men dey press die, see as lecturers kukuma don turn house lesson teachers & some dey roger kabukabu wit dia moto...See Blood! See Blood!! See Blood!!! Richmen no worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do.Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger...dat willkeep u glued to d edge of ur seat. Ugo laff, u go cry and u go reason sef.ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .Grab ur copy now! Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck Jonathan, Pete Edochie as Nassir faggie, Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Prof. Ruqayyat, and Olu Jacobs as Gabriel suswan & Jim iyke as Yahoo boy & Saka as poor man o! ASUU STRIKE 2013!Grab ur copy now! By luked
Posted on: Tue, 01 Oct 2013 20:49:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015