Yesterday, I was driving down SAPELE road in Benin, having just - TopicsExpress



          

Yesterday, I was driving down SAPELE road in Benin, having just finished answering a call when a police man suddenly opened the passenger door, entered and jammed it. As usual he wanted something from me for calling while driving...Then suddenly he saw the big Rottweiler dog Jackie at the back-seat with tongue stuck out, spitt dripping and fangs barring, staring fiercely at him... POLICEMAN: [Shaking] Ah! You carry dog? ME: [I bone face] Yes I carry dog, dat one na offense? POLICEMAN: [Feeling uncomfortable] Na where una dey come from? ME: From hospital POLICEMAN: Ehen! you sick? ME: No, na person wey d dog bite we go see, the person almost die sef POLICEMAN: [Terribly shaken by now] Ehen! but why d dog dey shake head like dat? ME: Na so im dey do if e wan kil person POLICEMAN: ah! and d dog know you? ME: Yes nah, no be my dog? Na only strangers e dey bite POLICEMAN: [Sweating] This your door, how you dey open am? ME: how you take enter? POLICEMAN: Abeg! Na since i dey try open am but e no gree open [The dog was now getting impatient and gave a small growl, its tongue almost touching the policemans left ear] POLICEMAN: [Now sliding forward] Oga i take God beg you, open the door for me make i comot, i no go collect anything from you ME: how much u go pay me? POLICEMAN: Ah! I neva hustle anythin since morin, na only 1k dey wit me. ME: U neva ready [attempting to release d dog] POLICEMAN: ok ok ok. e reach 2k, the other 1k na my wife own but I go give you join [now close to tears as the dog was becomin really impatient and getting ready to atack] Oga abeg take d 2k make u open d door plsssssss [sweating profusely] ME: oya bring am! [collects d 2k, lets him out of my car] POLICEMAN: God punish you idiot, e no go ever better for you and your yeye dog, wicked man.
Posted on: Fri, 23 May 2014 06:04:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015