#coughs ... #clearsthroat EHEN Dis na to officially warn some - TopicsExpress



          

#coughs ... #clearsthroat EHEN Dis na to officially warn some Naija babes say NO BE BECAUSE OF UNA, AMERICAN SOLDIERS COME THIS COUNTRY O. Dem come find girls Wey lost. YOU NO LOST. Because the way una dey celebrate these men different from how Chibok girls mamas and papas dem dey celebrate am. Una girls own pass becareful. The celebration and welcome pass the parents wey their pikin lost. Knowing wetin some Naija babes fit do, we dey plead with una to take am easy with the soldiers them. We no want make next time Obama wife carry placard, or make America go change the campaign to #BRINGBACKOURSOLDIERS. Ehen!!! Una know unasef O. Signed: Mc makopolo (President American Soldiers Waist Injury Prevention Organization - ASWIPO)
Posted on: Mon, 12 May 2014 08:56:19 +0000

Trending Topics



o
I am incredibly excited to announce that probably the best DJ I

Recently Viewed Topics




© 2015