f ASUU strike was a movie.. Na so the advert for be (Pidgin) Yes - TopicsExpress



          

f ASUU strike was a movie.. Na so the advert for be (Pidgin) Yes O! E don happen again o. Wealthyman Films in association with La Wealth Pictures presents another blockbuster "ASUU STRIKE 2013". Dis one na movie wey pass movie ooooo. Dem no dey tell person dis 1 oooo, u must to watch am by ursef. Come hear the true story behind the whole Asuu Strike ooooo- who start am, why dem start am, who suppose end am and who no gree end am ooooooo! U go see all for dis movie. Money don scatter our country ooooo, dis 1 dey ask 4 money, dat 1 say no money..... ewoOo ooo!!!.. Chai!!! come see as university students dey suffer, see as crime dey increase. Girls dey born like fowl, yahoo men dey press die... See Blood! Blood!! Blood!!! Rich man no even worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do. Kai!.. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Suspense full am, intrigue, romance, swagger, ginger... That will keep u glued to d edge of ur seat . U go laff, u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Directed By OLA a.k.a Wealthyman Starring: Kanayo. O. Kanayo as Goodluck Jonathan Pete Edochie as Nassir faggie Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Ruqayyat Ahmed Rufai and Olu Jacobs as Gabriel Suswan.. Jim iyke as yahoo boy, Hafiz Oyetoro aka Saka na poor man oooo. ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now..!!!.
Posted on: Wed, 25 Sep 2013 15:04:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015