my first semester exam G N S questions and my correct ans q1 he - TopicsExpress



          

my first semester exam G N S questions and my correct ans q1 he who laughs last? ans:get brain damage..need immidiate psychriatic treatment cos na beginnin of madness be that.. q2 all works and no play? ans:oga na bank job e be oo q3 a patient dog? ans:don get problem cos na hunger go kill am q4 once beaten? ans: na revenge go follow am o q5 an apple a day? ans: na hunger go wire u jeje q6 a journey of a thousand miles? ans:na the person wahala..y ein no enter car or last last keke sef q7 he who fights and run away ans:e don surrender be that nah..na fear catch am q8 a rolling stone? ans: no fit just roll na person push am q9 he who lives in a glass house? ans:na rich politician wey em be q10 birds of thesame feathers ans:na thesame mama born them q11 one gud turn? ans:na only power steering fit do am q12 half bread is better than? ans: puff puff,burns or garri without sugar q13 a friend in need ans:abeg na parasite em be q14 a fool at 40? ans:that one na small u no see naija wey be fool at 70.. abeg miterand neva pass? na my A course jare
Posted on: Mon, 10 Mar 2014 12:44:57 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015