my people i salute una o......sumtyms i go dey imagin if wetin dis - TopicsExpress



          

my people i salute una o......sumtyms i go dey imagin if wetin dis our nigeria army dem dey do4sapele na,d instruction wey dere give dem 4office...yestaday for were i dey make call for sapele water side b4 i know i com see people dey run..i no know wetin dey happen.na me self run follow dem..after 5mins of relay race.i com rest small com ask y there dey run..i com finally find out say na army dey pursue people like dog.just becuz of those people wey dey sell desel...my people only for dis mornin we com hear say dead bodi of a man dey float for waterside.we understand say na army kill dis man yestaday wen dere dey pursue people..buh just bcuz na water there shut am datz y d dead no appear till dis mornin....since morning for sapele waterside..people just dey cry bcuz dis bros na person wey pain,people..army com recome com dey pursue people..dis tin vex youth for ogwanja and waterside d youth dem com mobalize say dere wn fight..but tank say ejele dem interfare as we talk now d mata dor,cold like d pure,water wey i put for,fridge
Posted on: Mon, 26 Aug 2013 16:32:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015