no sabi bible. Make I share this one with una to redeem my image.- - TopicsExpress



          

no sabi bible. Make I share this one with una to redeem my image.- Psalms 23:1-6 1. The Lord na my shepherd, I dey kampe 2. He make me siddon for where beta dey flow and come put me next to stream make my bodi thermacool. 3. He panel beat my soul and come spray am white. He come lead me dey go though express road of righteousness for sake of him name. 4. Walahi! If I waka pass where armed robbers, 419 and juju people borku, come join okada reach valley of the shadow of death sef, I go stand gidigba cos Baba God dey my side. Him rod and staff nko? Those ones dey like backbone dey comfort me. 5. You don prepare banga soup with starch make I chop. All my enemies dey look ayanya. You rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup nah Ogunpa river wey come overflow hin bank. Welcome 2 september. 6. True true beta life and mercy go gum my back till I quench. And I go tanda for God house sotey sotey sotey, ti ti lai lai. God almighty nah you biko! Thk 4 d life u give me
Posted on: Sun, 01 Sep 2013 13:21:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015