woman wey get long-throath no fit do anything without long - TopicsExpress



          

woman wey get long-throath no fit do anything without long throathing o bcos as for church I dont expect what I heard in this prayer o: One church for naija dey do singles convention. The pastor raise prayer point sey all d singles should pray for dia hearts desires. Na im wan sista begin pray “oh lord, I no wan marry short man, Holy Ghost , I no wan marry short man, Angel Gabriel if you take eye see short man wey dey come my side use holy ghost fire bind am” E come be say one short man dey beside di sista dey pray im own sey ” oh lord, you know sey I be short man but I be billionaire”. Immediately di sista hear the word ‘billionair’ prayer com change. She begin pray say “oh lord! Na your voice be dat? how I go com say no, lie lie. I go marry di content and ignore di container”
Posted on: Sun, 14 Sep 2014 10:41:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015