Arsenal fit open gap for Premier League tabul reach - TopicsExpress



          

Arsenal fit open gap for Premier League tabul reach seven points if dem go fit win Cardiff City wen dem enta Wales play dis weekend becos de nes teams wey dey follow dem go play de nes day. Wenger sef go dey scratch head find de team wey hin go play becos Cardiff do Manchester United strong tin take draw 2-2 wit dem las weekend wey mean say dem no go easy at all. Theo Walcott fit start de match afta hin play for de gunnas las two matches since hin come back from injuri, same tin wit Mikel Arteta as Wenger go wan rest Mathieu Flamini, but one playa wey go wan play na Aaron Ramsey. We don tap beta ball since seasin don start and I dey hope say we go kontinu like dat, Ramsey wey start hin career for Cardiff City tok. Our form for New Year na dies dis pass seasins. So our mind dey say we mus tie trouser well well, becos confido dey say we go show swagga for de New Year. Na to win cup dey our mind now jus like any oda seasin, dis one sef no differen from oda ones, but bifor na us dey come from back dey chase oda teams. Liverpool, wey dey numba two for tabul go waka enta Hull City side on Sunday as Chelsea, wey dey dia back for gol diffrence go jam head with Southampton wey dey numba five. Chelsea see shege for Champions League as Basle beat dem and manaja Jose Mourinho don comot yarn say hin go change de team small. I get playas wey to play two matches inside three days dey worri, hin tok We go siddon luk am see how we go change tins, no be say we wan punish anybodi oh. I no dey punish playa wen I know why dem play like dat, but na to use de team. Manchester City wey dey fourth, go wan kontinu dia fine form wey see dem beat Plzen for Champions League wen Swansea show for dia side. Robin van Persie and Nemanja Vidic wey dem two miss United match for Europe go hope say manaja David Moyes go gif dem shirt as dem go face Tottenham Hotspurs wey go wan revenge de 6-kondo wey City nak dem las weekend. Tottenham market dey peri-peri even upon all de kulele wey dem troway to buy playas bifor seasin start and fire don dey hot for manaja Andre Villas-Boas seat. I get confido say de board and de playas dem dey supot wetin I dey try do for hia, Villas-Boas yarn for press conference dis week. Wahala no dey now. I sabi dis kain parade wen I bin dey Chelsea dat time, but e no dey worri me. I no send at all. Na onli press pipu sabi dis kain tin dey drop pressure on top pesin. Everton fit enta de top four if dem win Stoke City, and Sunderland wey dey last for tabul go travel go play Aston Villa, as Crystal Palace wey be Sunderland broda for bottom tabul go waka go Norwich side. West Ham go jam Fulham as Newcastle and West Bromwich Albion go fire each oda. Na all de matches for Premier League be di
Posted on: Sat, 30 Nov 2013 07:46:57 +0000

Trending Topics



resting comment to Cyril Takayama enchantements..
TIPS & TRIK : ========= Cara Download Video YouTube melalui
Members, again its time for a reminder..... Please be aware that

Recently Viewed Topics




© 2015