MY LOVE, NA MY BEST BI DIS Dem dey talk am say relationship go - TopicsExpress



          

MY LOVE, NA MY BEST BI DIS Dem dey talk am say relationship go only fit grow wen bi say d people wey dey 4 d relationship don talk from dem mind say go dey responsible and love unconditionally and don agree say anything wey wan happen make e happen dem go dey honour demsef, stand by demsef and dem go dey give demsef d best. But d kind relationship we Naija people get 4 we Contri no bi correct 1 na 2 loot d tax payers money 4 dem pocket na him we know. Many Naija people don run komot 4 we Contri bcos dem wan go look 4 gud like 4 demsef 4 anoder contri and d 1 wey remain dey pray say make better connection come dem way so dat dey 2 go fit share inside d National cake as dem dey call am. And some people dey talk say all d wahala and magomago wey dey happen 4 we contri no kuku concern dem bcos e no near dem family. Nau na d question bi dis how relationship go take grow wen bi say everybodi dey waka komot 4 d contri or no fit wait 2 waka komot 4 d contri wey oyibo dey call emigrants? How relationship go take grow wen bi say 1 half jus dey look 4 awuf chance 2 kolobi from anoder pesin? How relationship go take grow wen bi say nobodi wan help anoder pesin? Na him come make us dey remind wesef say time don come wey bi say make we wake up and 2 make dat relationship wey dey between us and we contri grow and waka well well. Na him bi say your contri want you pass wetin you dey think. TIME TO WAKE UP!!!!!!
Posted on: Tue, 24 Sep 2013 09:01:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015