Mede mede xtra My people Merry Christmas!!!! to una.We pray say - TopicsExpress



          

Mede mede xtra My people Merry Christmas!!!! to una.We pray say dis season go bring better things come for una. Amen! My people Chelsea boss Jose Mourinho don come out to yarn say Footballers wey dey play for Britain deserve respect sake of the hectic festive fixture programme,The Blues go play five matches in less than two weeks.Boxing Day go see chelsea gbege West Ham while further Premier League matches against Southampton and Tottenham go follow before their FA Cup third-round jam wey dem get against Watford. My people Shey make EPL sef dey go break as other leagues like La Liga, Bundesliga , Ligue1 and Italian seria A dey go? Na wetin una feel say be the effect of dis break wey dem no dey go? Oya make we yarn am.
Posted on: Thu, 25 Dec 2014 13:06:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015