One time Supa Eagus coachi, Samson Siasia don tok say him belle - TopicsExpress



          

One time Supa Eagus coachi, Samson Siasia don tok say him belle dey sweet am with de lass two games wey de Naija team don play. Naija wey na dem be de Baba for Africa bulala Malawi 2-0 lass Saturday for Calabar for de world cup kwalifia match. Oga Keshi kon carry him Boys enta Kaduna and naso de Eagus take Burkina Faso drink garri as dem skatta dem 4-1 for de padi padi game wey dem play yesterday. “Supa Eagus playas dey try well well and de way wey dem take hamma Malawi and Burkina Faso dey sweet me. “Malawi carry plenty gragra come Naija as dem been wan distract us, but our Boys tell dem say dem too small to cos wahala for Naija,”. Naso Oga Siasia tok. Supa Eagus don make am to de lass 10 countries for Africa wey go fite for de ticket wey dem go take enta plane go Brazil ness year and Siasia tok say Naija go make am. “I no dey even think dat one bicos I know say Eagus go tap ball for de 2014 world cup bicos na dem be de Baba for Africa,”.
Posted on: Wed, 11 Sep 2013 18:31:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015