P.m News/Updates. 26/12/2014. Report enter studio now say - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 26/12/2014. Report enter studio now say dem just discover the dead body of one young boy wey dem dey call William wey dey stay Uko road,dis morning. The boy dey work 4 somewhere wey dem dey call Marybet abi na Naira bet. He go out go drink last nyt for Christmas day,na for Abeke Road some Gana area vigilantes guys, wey know am well, carry am go house for Night wey dem see am dey stagger for Road alone beyond himself,before day break the boy don die,the body stil dey the house there before i commot dere,the papa and brodas don come. Nobody know him friends wey he folo go out go drink. Atink SAPELE TAFIA warn unu before now,for one of my post? Report enter studio say Paul Police wen get IDON HOTEL and the highest Tatoo guy from old Germany Jolomi Boyo wen get illegal woman for House as wife just dey enjoy themselves dey dance for IDON Hotel yesterday. I perch for the ceiling dey view dem,as Jolomi Boyo intentionally insult me becos of drink for where my MARIAM JASPER dey. I use shame take keep quiet becos i know say my power na my mouth and my fingers. From the latest M.C groom and Tatoo Bride wey don be couple now due to say,dem two use Otishe take agree to marry before God cum ordain am for dem (na joke oh Lolz). Mr and Mrs Ubogu Vieri Rukevwe wen almost use chair kiss him wife for e wedding feast due to perfect height, throway endless greetings to the entire members and safarians worldwide for the financial,moral,kind and prayerful support wen we give them before and during the start-up time of their marriage. Them say make i salute unu and make i pray for unu say God go make us gada again for a better reason courtsey of unu. God bless unu again becos of Rukevwe and Ejiro. We throway special greetings give DOUBLE CHAIR Richard Continental Hotel and Hon. Francis Maku,along side Jolomi Boyo as these two don finally give us deir RICE promise. Also one person support us with N5,000 from NIKORO ESTATE so that we fit also put smiles for d faces of the poor,less privilege ones and widows within Sapele and Delta State. God bless unu. We still dey wait for Moses Ogodo 4Bags of Rice. Report climb ceiling enta studio say yestaday wey be xmas wey pipo dey go jollifikate, d workers wey dey work for Edahirere Road dey on standby yestaday as dem work till day dark. Naso dem use gate take block d road say no motor go pass. D workers dem work well, well as dem don begin to dey do d drainage system to standard. I still dey observe unu as D materials wey unu dey use nor too dey pure for my eyes. Report don reach us say many keke for d town do ova loaded since xmas watchy nite enta xmas day and today boxing day. Due to d scarecity of keke dis few days, many of d triciycle riders don take advatage as dem dey load up of 7 or 8 pipo inside one keke. Some pasenjas even dey tama dey shuk head dey come outside for the keke. We dey use dis update take dey warn all keke riders to apply safety becos tuke-tuke nor get breeze for anus. Our studio don taya to dey report Mr and Mrs Omasan Mabiaku a.k.a Olololo matrimonial issues,becos the couple nor dey try at all. Yesterday dem two disgrace themselves for Otite Road,as the man beat hell out of the woman becos the woman say,she see her Hussy with anoda Girl dey play love for deir compound during the time wen Acure go Omasan House go eat. I don throway calls for dis both persons but pride nor wan let the two persons apologise to eachother. Make unu helep me advice dis two people becos the woman know how the man be before she marry am,so i think say understanding suppose dey inbetween the lines. The question be say; 1: E good make woman dey find man follow town weda he carry Girlfriend dey waka? 2: E good make man beat him wife with wood and use chain tie her make she for nor commot again? God Bless Sapele. HAPPY BOXING DAY. OYA MAKE UNU TUNE INTO SOUND CITY DEM WAN KILL ME WITH MUSIKI. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 26 Dec 2014 20:07:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015