The gol wey Supa Eagus midfielder, Rabiu Ali score for de mortuary - TopicsExpress



          

The gol wey Supa Eagus midfielder, Rabiu Ali score for de mortuary time na hin helep Kano Pillars carry dia bag waka go fess again dis season for de Naija League as dem hama Akwa United 1 kondo for de reschedule week 23 game wey dem play on Wednesday for Kano. The game na Naija League match wey no fit shelle lass month as Kano Pillars moto jam for road de time wen dem been dey go back to Kano afta Warri Wolves skatta dem 3-0 for de Federation cup win or waka match for Ilorin. Akwa United do de Sai Masugida shege for de fess haf as Tenger Boys no gree open yarns at all for de aboki Boys. Supa Eagus strika, Gambo Mohammed waya one kind wicked shot wen dem start de second haf, but Akwa United goalie, John Gaadi parry de shot kommot and na de corner na hin Kano Pillars take score de gol wey wound Akwa United. The koko now be say Kano Pillars don dey top de Naija League table again as dem don gada 51points now from de 29 games wey dem don play. Oga coachi for Kano Pillars, Mohammed Baba Ganaru kon yarn us for supersport dat na dat fess position na hin im Boys go take sitdown till dis season go finish. “Now wey we don dey top again, na to sleep dia dey our head as we don carry matras go dia and nobody go fit kommot us for dat fess position bicos we wan carry de trophy again,”. Naso Ganaru yarn us for supersport on Thursday. Kano Pillars dey waka go Lafia dis weekend wia dem go jam Nasarawa United for dia Naija League week 30 game. Meanwile, na Sunday na hin all de Naija League week 30 games go shelle as de LMC people wey dey control de League tok say make all de Naija League clubs take Saturday troway support for de Supa Eagus of Naija wey go jam Malawi for dia lass Group world cup kwalifia for Calabar. “Na 4 kondo na hin I wan make de Eagus waya dem for Calabar bicos wetin dia coachi (Tom Saintfiet) tok dat time no gud at all and I wan make dem pour pepper for him face make hin know say Naija no be dia mate,”. Naso Ganaru tok. © supersport Tweet
Posted on: Thu, 05 Sep 2013 11:16:56 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015