We grew up where we didnt enjoy football. Playing football match - TopicsExpress



          

We grew up where we didnt enjoy football. Playing football match with Okpoga boys those days was terrible. U must not win them. Winning them was so needless cos ull want to avoid going home with broken heads. Play with Otukpa boys na another wahala. Na palm wine dem de drink for half time as refreshment so second half de dey very awkward. If referee blow wey u ask am e go say na mistake. Go Otukpo, everybody be over-age. Otukpo boys no de ever finish secondary school. If u come play match for Ugbokolo na there wahala full pass. The only referee wey dey there that time na police, him name na wayas. If u commit foul for field u go collect three things at once; slap, yellow card and red card at the same time. Even goal-keeper sef no de gree say dem score am goal, one of dem is Emmy Jay. The only two strikers for the whole Ugbokolo no fit go far bcos dem no de wear boot. If dem wear boot dem no fit score. Ikpekpeju and Pauluser. At the end of the day Orokam and Ado remain the best. Check the Super Eagles and see for urself.
Posted on: Thu, 17 Jul 2014 20:40:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015